This na example of the kind big big things wey go shele for music industry for this 2018.
Tiwa Savage don dey plan to do one on point collabo with Nicki Minaj and Rihanna.
This na the first time since when Tiwa Savage don start to dey sing wey she go do collabo with any international artist and she no even start small at all, she don choose two out of the top international musicians for the collabo.
No be the only thing be that o, Tiwa Savage go also bring Rihanna and Nicki Minaj together for one song after the hot beef wey dem get last year.
Wetin una think about this one?