Celebrities dey like to dey make everybody dey talk about them all the time.
Naija Celebrities self follow for this level and based on this, dem go dey do anything to make people dey talk. One of the things wey dem been dey do na to make naked foto and carry put for online.
PidginBlog don carry torchlight take reason their matter too and na the list of celebrities wey don pose naked be this for Naija.
- Kaffy
Top for the list na Kaffy. Kaffy been drop one correct naked pose for Instagram. Plenty Naija pipu been yab am steady based on how we dey do then now but the mata don pass now.
2. Beverly Osu
Former Big Brother Africa housemate been release her book then wey she call, “Beverly Book of Pose”. The book been carry plenty plenty naked picture and na just small be this for here.
3. Selebobo
The next celebrity na Selebobo- nobody even sabi where him dey again these days.
4. Ini Edo
Popular Naija actress don drop one naked picture too for boys and girls make we flex on top as she drop this one that year for BellaNaija alone. Plenty people curse am as usual now but based on no be so she be normally, some people still defend am.
5. Damilola Adegbite
Former Tinsel actress, Damilola Adegbite drop this foto when she been enter 28 years of age for Instagram. She dey always drop some kain sexy levels as she dey celebrate her birthday and this na one wey she drop for 2013.
6. Genevieve Nnaji
Genevieve na everybody dream sugar mummy for Naija and when she been drop this picture that year, people been love am based on who she be. She no dey ever grow old.
YOU FIT ALSO READ: PidginBlog Interview One of the Alleged 57 Gay Wey Dem Arrest for Lagos
7. Orezi
Orezi been drop this one like e dey hot when he been want release him album that year. Naija people no even care say na Orezi that year wey him dey hot, dem clear am.
8. Oge Okoye
Oge Okoye na one before before popular actress wey dey drop sexy pictures steady for Naija people. See some of the pictures wey she been don drop before.
9. Dare Art Alade
Before Before Musician turn show promoter, Dare Art Alade don drop one kain naked foto of himself when he been want release one album wey him been call Naked.10. Charly Boy
If you no sabi Charly Boy – you be small pikin be that. No story on top him mata. Baba don old now so him no dey too cause wahala now.
YOU FIT READ; Wetin Scientists Talk About Small Bobby People
11. Cynthia Morgan
This story no go complete if we no include the one and only Cynthia Morgan wey dey peper us before for Naija. But e be like say her pepper, sun don dry am comot as she no gree sing again these days.
12. Small Doctor
The last but not the least person for this list na the one and only Omo Iya teacher. Him been post video for him Snapchat naked and him dey stroke him kokoro. Some people been yarn say him been want carry the video give one shenke but the video carry enter public eyes.
ANOTHER TORI: Barça ear Don deaf, Dem Wan Buy Coutinho by Force, Carry Armor Tank of Money Come
Nawa o, even kaffy follow for this show of shame