December dey here, plenty plenty things go shele, from billings to chopping to partying.
We get advise for guys, and na say make you try give your girlfriend something dis December.
Those things wey be say you never give her since January, oya man up and give am
1. Bros, Buy new phone for her β»
Bros that her phone don dey hang, try buy new one, you hear? D phone nor be hanger π
2. Give Her Plenty Money
E get some goals wey she don set, and she still wan achieve am dis December, oya give her money, make her head swell βΊοΈ
3. Buy new Jewelry wey fine for her
Birthday Parties, weddings, etc go dey dis December, you nor go like make she brag say na “Romeo buy am for me” when her friends dey talk say “Awnn dis Jewelry fine well”?
You go like am nowπ, oya sharp sharp enter market go buy am for her
4. Open Supermarket for her
Bros, shey you go like am if person dey call your babe “fine girl wey nor get money?”
E sure say you nor go like am, oya na why you need open Supermarket for her, make she self get steady source of incomeπ
5. Buy bags, heels, sneakers, wigs for her
When dem wear these things, e dey compliment dia dressings, and naim dey make you shout “wow“, “babe you set”, “babe you fresh” and oda tins wey you dey always talk.
Oya nor waste time, go buy am sharp sharp ππ
Wahala for person wey get babe ooππ
We wan make dem buy home straight too oh
Bone straight abeg
Me wey dey look for sugar mommy weh go spoil me as my birthday dey approach….well if I see sugar mommy.. I’ll buy bone straight hair give am sha