Lagos state PDP Chairman oga Deji Doherty dom yarn say APC dey put Lagos state inside big debt and say dem fit put Lagos for bankruptcy if dem no comot dem for office for 2023.
Mr Doherty bin yarn dis wan, wen hin be receive Babatunde Gbadamosi and hin supporters wey defect come d People’s Democratic Party, PDP.
” E dey shock me wit d way APC led Government dey take put Lagos state inside Debt, something got stop dem before dem go make d state go bankrupt”
Doherty bin give Gbadamosi and hin supporters kudos say dem quickly come back early and say e go give dem time wela to work for d success of d party for 2023 for d state.