Prof Ajayi Boroffice wey b say naim b d Senator wey dey represent Ondo North senatorial District don yarn say d ruling All Progressives Congress, APC no get opposition wey fit shake dem for dis year election and say e go to easy for APC.
Hin yarn dis wan for one empowerment programme wey dem do for Ondo state for weekend, for Akoko North-west Local Government, for 144 women dem, and 50 k kpogiri bin enter d women hand dem.
He yarn say all d party members don dey work as to say make APC retain power.
“For d election Mata, we dey work hard on am, and we dey prepare wela, na we dey win d election, tori no dey for dat one again”