Based on level dey be for Nigeria, Microstation don yarn us say dem don get plans to take sama plenty plenty people ogbonge TECNO Spark phone and some use inside house things dem wey be like Iron, kettle, blender and other awoof dem to dem fans wey dey online.
This promo na wetin dem be call Independence Awoof promo and based on say na Independence season kwa, everybody go wan follow chop one or two awoof dem based on logistics na. As we dey talk for street na say who no like beta thing make e talk.
Make person sama me new phone now, na with joy and love I go take reason am and na wetin Microstation be dey do now kwa.
Wetin you go need do no long at all at all, just follow this waka take sama your own level
- Follow Microstation for their Facebook page
- Answer questions wey dem go dey throw everyday
- CHOP! CHOP!! CHOP!!!
According to the Digital Marketing Manager, Mr Raji Lekan wey follow us relate, “him say this level go sweet for the fans dem and dey go enjoy am no be small”
So, our people dem,wetin una dey wait for na, make una carry unaself enter Facebook page of Microstation take collect una own phone abi home appliances wey Microstation dey take dash we people for this Independence Awoof promo
E sure us say some people just dey carry eye look this and we want talk say e never late o as na tomorrow the awoof dey start na and this one na, e full ground berekete
Tecno and giveaway na like twins, dem dey inseperable
Make i run go their fb page, make this awoof no pass me by
I hope say this promo still dey on…I no fit miss it.